- You go appoint a Banker, Bayo Adelabu wey na monetary matter him know about all him life as Minister for Power.
Sadly, under Bayo, national grid done collapsed more than 8 times within 8 months, and Megawats don drop patapata from 2,000Mw to 450Mw. Sotey some Discos dey receive Zero Mw.
- You appoint an information (media) guru, Dele Alake as Minister of Mines. Person wey every Nigeria know say na talk him sabi talk.
Nothing dey mine nau. - You carry a whole trillionaire wey get many companies both home and abroad, Atiku Bagudu take do Minister for Budget & Planning.
Wetin him want plan past him business and political empire. - You appoint tax collectors and commercial bankers, Wale Edun and Yemi Cardoso as Minister of Finance and Central Bank Governor as if you know dey this country wen Obasanjo spent millions of dollars to get technocrats like Ngozi Okonjo-Iweala and Charles Soludo to help his government stabilize the economy and financial sector.
Kemi Adeosun and Sanusi Lamidi Sanusi also did their best under Jonathan and Buhari’s government.
Meanwhile, Adams Oshiomhole warned the Senate make dem no approve appointment of commercial bankers like Cardoso to handle monetary policy of the country.
- You appoint boyfriend and girlfriend, Olubunmi Tunji-Ojo and Beta Edu as Minister of Interior and Humanitarian Affairs. But later sacrificed Beta for Tunji-Ojo wey the entire world know say he follow chop inside Betagate scandal.
- You still come appoint your younger brother, Isiaka Adegboyega Oyetola wey fail woefully as a sitting Governor sotey him opponent defeat am take do Minister for Marine & Blue Economy.
Person wey no know anything about marine sotey the blue economy sef don turn to black economy.
Economy team or federal executive council no be for political patronage or compensation at all.
I swear, Tinubu don put everything and everybody in Nigeria for reverse.